back to top
HomePoliticsYerima escape assassination attempt: Police deny assassination attempt on Naval officer wey...

Yerima escape assassination attempt: Police deny assassination attempt on Naval officer wey tackle FCT minister Wike

- Advertisement -


FCT Minister Nyesom Wike and Navy officer, Lt Ahmed Yerima

Wia dis foto come from, Lere Olayinka/Facebook screengrab

Tori say dem wan assassinate one Nigerian Navy officer, Lt Ahmed Yerima for Abuja na lie, police tok.

Di Federal Capital Territory Police Command dismiss di tori say Yerima survive assassination attempt – dem describe di claims as “false and unverified.”

Police make di statement on Monday morning afta tori spread say some unidentified men wey wear black inside two unmarked Hilux vans without number plates in Abuja dey follow di Naval officer.

Local media say dem begin follow am around 6:30 p.m. for NIPCO filling station along di Kubwa Expressway and kontinu to Gado Nasco Way.

Tori be say Yerima escape di attackers with speed. But police say all dos tori na lie.

Josephine Adeh, di tok-tok pesin of di Federal Capital Territory Police Command say nothing like dat happun and nobody don report anytin like dat.

“Di FCT Police Command don hear tori wey dey spread on social media wey allege attempted assassination on Lt. Ahmed Yerima.

“Di command wish to categorically state say no such incident don dey reported or recorded anywia e within di Federal Capital Territory.

“We advise di public to disregard dis false information and stop to dey spread unverified claims wey fit cause unnecessary panic,” di statement she tok.

Background of Wike kwanta wit Yerima

Na serious drama wen Nigeria minister of di Federal Capital Territory (FCT, Nyesom Wike and military officials enta kwanta ova mata wey surround land issues.

Di gbege happun wen di FCT minister wit some officials bin dey enta one land and military officers bin stop dem.

Wike, former Rivers state govnor bin vex well well as e face di soldier wey lead odas to stop am ontop di land wey dem bin wan gain access into.

Di minister kwesion di military for di approval wey dem receive to dey ontop dat land or to develop am.

As di minister dey vex dey tok, di soldier stand for im front calm and dey reply am evri kwesion wey e dey ask.

Wike ask di officers to show di document wey dem get for di land wen dem dey guide.

“Show me di document wey you get, you no get document. I be minister you no fit tell me dat. We no fit dey kontinue to get dis imounity, we no fit dey kontinue dis way.”

“Wia di approval wey dem give you, how dat man for im level, even if e get problem make e write and say see wetin I get, but e go send soldiers to who intimidate who.”

Meanwhile, di military officers say dem dey act on order wey one of dia ogas bin give dem.

Naso Wike vex shout ontop di officer say nobody dey higher dan di govment and nobody go fit intimidate am.

“You no fit dey higher dan any govment, you no fit dey carry gun to intimidate pipo make dem no do dia jobs,” Wike tok as e address di officers wey dey stop to enta di land.

One of di milliary officers wey dey follow Wike tok make am clear say dem get document for di land, and dem get am legally, but di minister disagree.

As di hot drama dey go on, Wike and di soldier dey throw words at each oda but while di minister dey use serious face to take cut warning give di officer, di military officer just dey calm dey stand on im words say im dey act on order.

Afta di whole kwanta, Nyesom Wike follow tori pipo tok on wetin carry come ontop dat land.

E say di land bin dey act on dia mandate wen e hear say dem use military take chase dem comot, na why e imsef gatz stand say e wan go see tins by imsef.

“E dey unfortunate, na dis kain tin dey trouble our development. Di land department get di mandate to see wia illegal development and land grabbing dey go on.”

“Wen dem come hia, dem say di military chase dem comot, I think say dem fit dey act illegally. Wen I dey office, dem call me say di military don take ova di place, I gatz come see tins for mysef.”

Dis drama cause plenty tok-tok and reactions for Nigeria sotay, many pipo begin check wetin law tok about who get right pass.



Source link

RELATED ARTICLES

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

- Advertisment -

Most Popular